| |
Uefa don vex well oh! the Europe futbol ogas dem don slap Paris St Germain strika Zlatan Ibrahimovic come nack am two match suspenshun for Wednesday as per the red kad wey in kollect for the Champion Lig round of sixteen fes leg wey dem play wit Valencia.
The Sweden guyman bin chop strait red wen match nearli kpai afta in enta Valencia defenda Andres Guardado anyhow, the studs for in boot sef show as in jam the playa for the match wey PSG win 2-1 for Spain for Februari 12.
As e b, Ibrahimovic go miss the retun leg for Paris for March 6 and the fes leg for the kwatafinal if PSG manage qualify.
At the same time Uefa don troway the apil wey Schalke 04 apil say Galatasaray strika Didier Drogba bon no suppose play for the fes leg wey dem play for Istanbul for Februari 20.
The Ivory Coast playa bin enta the Turkey klub wen Januari transfa nearli finish from Shangai Shenhua. The China team sef bin try blok the transfa as dem dey klaim say no b like dat dem gree wit Drogba for in kontrak.
"We don kuku siddon luk all the paper and tori wey dey the case,and the kontrol and disiplin bodi don gree say Schalke protest no get oil at all, come reject am" Uefa tok for statement wey comot.
Aucun commentaire:
Enregistrer un commentaire